Liverpool news

ISak to liverpool reach final Agreement , Done deal its official

Written by Uduak Obong

alexander isak don finally get hope say him dream move to liverpool go happen this summer the swedish striker wey dey play for newcastle united don dey confident say the deal dey move in the right direction and e go soon complete am this matter no be rumor again according to wetin tbr football report them talk say negotiation dey go on between the two clubs and some strong agents wey sabi the game don dey work behind the scenes to make sure everything go well

the report come reveal say liverpool never submit official bid yet but them go only do that one once them confirm say agreement dey close and everybody don ready according to tbr football once the deal finally go through e go break british transfer record and liverpool don already prepare say them go pay alexander isak more than three hundred thousand pounds every week if that money happen na only mo salah and virgil van dijk go dey earn more than am for the liverpool team

the wahala now na newcastle united wey no wan allow isak comot unless dem first find correct replacement wey go enter that number nine position because isak na their main man and dem no go wan just let am waka like that especially as dem dey prepare for new season and dem still dey hope say dem go challenge for top four and champions league football the club don already start moves to find who go replace isak but them never conclude on anything yet so the deal dey hang for that side for now

graeme bailey wey be the chief correspondent for tbr football talk say people wey dey close to isak don confirm say him already talk say him wan leave and him eye don focus on liverpool no be say him dey misbehave or cause wahala for newcastle but him don decide say this na the time to take next step for him career and liverpool na the club wey dey give am that chance

newcastle fans don dey observe everything and many of them don begin accept say isak fit comot before the window close even though them no too happy about am at the same time them believe say the club go use the money wisely and bring in another strong striker wey go continue from where isak stop

for the side of liverpool fans everybody don dey excited since the story break many don already dey imagine how isak go take blend with arne slot new style of play and how him go combine with the likes of darwin nunez mo salah diaz and jota if salah still dey by the time the season start some fans even believe say with isak the team go fit challenge for premier league title again and maybe return to champions league with full force

About the author

Uduak Obong

Leave a Comment